Prime News Ghana

Check out: How BBC Pidgin reported Akufo-Addo's birthday wish to Shatta Wale

By BBC
shata_wale_and_nana_addo
Shares
facebook sharing button Share
twitter sharing button Tweet
email sharing button Email
sharethis sharing button Share

You fika say na only fresh boys den girls get Pidgin swag? You for make steady! Favour Nunoo, Accra-based journalist, just report say President Akufo-Addo for Ghana drop just one pidgin flow for Twitter and social media for Ghana don scatter.

People wey tink sey na only English den slang President Akufo-Addo fit speak dey inside shock no be joke.

Di gist be dis; popular dancehall artiste for Ghana who dey celebrate im birthday on 17 October carry tweet ask President Nana Akufo-Addo what im dey give am as birthday gift.

Dis be where the unexpected don happen, President Akufo-Addo as ei want reply Shatta Wale do am for Pidgin inside too.

Make u see Shatta eim response:

 

 

Di 73-year-old President for Ghana once again show eim people sey he still be young at heart, eim market don come.

During the 2016 election, as Presidential Candidate for New Patriotic Party (NPP) na picture of am wey dey suck Kalyppo juice which primary school pupils dey love pass scatter everywhere for social media.

Ghanaians start Kalyppo challenge self, so as eim pidgin don fall on Ghanaians like Davido ein banana fall on you popular lyrics - ei fit be sey Pidgin challenge go emerge? Well, we dey spy see what go happen.